TRENDING:

To Kill A Monkey – This nerve-racking, jaw-droppi...
WHO TO MARRY – Lina asked for one but now has one...
INSURANCE COMPANY – She returns home but things a...
OSHFILMS
  • Home
  • Hollywood
  • Nollywood
  • Ghallywood
  • British Drama

Select Page

Kill Boro – A film shot in the creeks of the Niger Delta and lives up to expectation

Posted by OSHFilms | Nollywood |

Kill Boro – A film shot in the creeks of the Niger Delta and lives up to expectationScore 100%Score 100%

My kontri pipo, abeg make ona nor vex, na pidgin English I go use take write dis one, sake of say na so di pipo wey act for dis fiim take yan! Dem sama di pitakwa pidgin English, nor be small tin oooo…e sweet me for body well well…dat wan dey!!!

Dis ogbonge fiim wey you see for hia so ehhhhhnnnn, if e nor pack plenti nominate or collect plenti plenti award for di next AMVCA ehhhhhnn…make I know wetin cos am 😩 Di fiim too sweet, God abeg!

I watch fiim sotayyyy I forget say na fiim I dey watch. I dey vex, I dey shout, I dey cry, I dey holler! Ah! Ah! Wetin hapun! 🙆🏽‍♀️ I gats pinch myself tell myself say make I calm down, say na fiim, nor be real life! E tooooo sweet me!!! All di pipo wey put bodi for inside dis fiim ehhhhnnn over try dey worri dem! Boro himself kukuma wear im actor part for bodi like kaftan…abobi dey act,…nor be sayyyy go-come! Normal normal, dat guy suppose collect award ontop dis fiim head!

Storyline:

Priye Diri naim write di tori wey dem use take act dis fiim! I throway salute gee am…in short make I pluck flawa for my garden gee am! She too much 🌹🌹🌹 For dis fiim, Boro (Philip Asaya) go borrow moni for bad man, Jaguar (Yibo Koko) hand. Jaguar give Boro 2weeks to carry pay im heavy moni back odawise kasala go burs. 🙆🏽‍♀️ Tins too hard for Boro family sotay im son Elijah (Kosi Ogboruche) nor fit go school again. Na so di boy sef come go join bad gang for dia Azuama community. Boro don frustrate frustrate ontop moni wey im nor get & di wan wey im dey owe Jaguar. Guy come begin dey drink drink anyhow, dey beat im wife Boma (Ini Dima-Okojie) and im pikin Elijah.

Dis tin vex Elijah…e pain am to di point wey im come plan sometin for im mind. 😳😳🙆🏽‍♀️ “Elijah be calming down!” Dis boy nor wan hia word again…di boy don vex nor be small! Na so everibodi begin dey run kiti-kiti dey run kata-kata; everi wia wan scatter, tins wan spoil be dat oooo! 🙆🏽‍♀️

Abeg my kontri people, if you never watch dis waterside creek fiim, you are on a long tin oooo; you dey miss! Dem chop pidgin for mouth like food (na dat wan sweet me pass). Di tori sef dey totori me for bodi. Di acting be real real! All of dem too try abeg! Mama Di Mama wey be old Nigerian fiim actress, Hilda Dokubo sef dey for dis one!

Dem finish work for hia…di cameraman, di way wey di wounds dem be like tru-tru, di place (location), persin fit relate. Di acting, over pure dey worri am! Dat small girl Orabere (Beloved Osagie) sabi act too! Dat Bossman/Atemie girl (Blessing Uzero), abeg I twale for dat girl…she cook her own pidgin by herself, she chop di pidgin come drink water ontop! 😍 Di girl dey yan abeg. Everi everi for dis fiim make sense!

Teeree gboza for all dem! Gboza! Gboza!! Gboza!!!

Di korect lessons wey I learn for dis movie be say:

🚥 Some kain times, wetin you dey find for Sokoto, fit just siddon gidigba, tanda for ya shokoto 💁🏽‍♀️

🚥 Anoda wan be say di good wey you do for some kain pipo yestaday, fit be wetin go save you tomoro.

🚥 Pipo life big pass moni! Moni nor be everi tin!

🚥 My mama dey always put wan parable say “if some tin wey wan kee you dey porshu you, wetin go save you dey follow am” Dem show am for dis fiim too

Di only tin wey pain me for dis fiim be say dem nor use Patoranking song “Abobi” Dat song for enter wella. But dat one dey sha…😊

I for give dis fiim 100/10 but e go be as e get 😅 so, oya make una manage 10/10…e sweet me for belle like dat 👏👏👏👏

You don watch dis fiim? Na how you see am?

Our Rating

100%

100%

Share:

Rate:

PreviousMY OXFORD YEAR – A romcom that derails; it fell short!
NextA Father’s Crime – He took the fall. She chose her happiness. Was she wrong?

About The Author

OSHFilms

OSHFilms

OshFilms is a movie review website. It offers insights into or gives unbiased opinions on past and newly released films or series from a wide range of movie industries (Nollywood, Hollywood, Bollywood, British Drama, etc). These movies cut across diverse genres (thrillers, action, romance, drama, horror, comedy, sci-fi, documentaries, etc). Oshuare Elizabeth Ombor-Pereowei is the Chief Editor and Lead Critic for OshFilms. Her social media accounts bear Lizzy Pereowei (“Lizzy Pereowei Writes” for Facebook).

Related Posts

LANDLINE – He is in a time loop. Can he pin it down?

LANDLINE – He is in a time loop. Can he pin it down?

15 July 2025

Unguarded – Is it her word against his or the other way around?

Unguarded – Is it her word against his or the other way around?

27 July 2025

SIN: First Blood –  Let’s just say a bad day couldn’t get any worse after this!

SIN: First Blood – Let’s just say a bad day couldn’t get any worse after this!

28 July 2025

Here Comes the Bride – If you love something, you take care of it!

Here Comes the Bride – If you love something, you take care of it!

19 July 2025

Leave a reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Recent Posts

  • RUSE 2: When trouble comes knocking Kabiru comes running
    RUSE 2: When trouble comes knocking Kabiru comes running
    Nollywood
  • UNSPOKEN SCARS – People see red flags in relationships but choose to ignore till it starts to haunt them
    UNSPOKEN SCARS – People see red flags in relationships but choose to ignore till it starts to haunt them
    Nollywood
  • TEST OF FAITH – Pastor King did not see that betrayal coming
    TEST OF FAITH – Pastor King did not see that betrayal coming
    Nollywood
  • Six Days Grace – Shall we continue in sin that grace may abound?
    Six Days Grace – Shall we continue in sin that grace may abound?
    Nollywood
  • A Lover’s Heart – He is broke, she is sick. Can he foot the bill for a surgery?
    A Lover’s Heart – He is broke, she is sick. Can he foot the bill for a surgery?
    Nollywood

Recent Reviews

  • RUSE 2: When trouble comes knocking Kabiru comes running
    Score: 55%
  • UNSPOKEN SCARS – People see red flags in relationships but choose to ignore till it starts to haunt them
    Score: 55%
  • TEST OF FAITH – Pastor King did not see that betrayal coming
    Score: 58%
  • Six Days Grace – Shall we continue in sin that grace may abound?
    Score: 30%
  • A Lover’s Heart – He is broke, she is sick. Can he foot the bill for a surgery?
    Score: 38%

Designed by Elegant Themes | Powered by WordPress